Abeg make una helep me for dis our obodo Nigeria o. Yesterday na BLACK Sunday as we hear de news again say anoder ADC plane crash for Abuja. In fact I no fit write anitin yesterday as my whole mind just spoil..may the souls of the departed rest in peace. Amen.
But come o, de news wey we hear be say de pilot no gree hear wen dem give instruction say becos weather dey bad make all aeroplane tanda for 10 minutes. Hmmm na wa. De question wey I wan ask na shay our airport don become like Ojuelegba bus stop where bus driver no dey listen to yellow fever? Abi how come we dey hear say pilot no listen to the caution of air traffic controllers ehn??
Akadaites, in fact talk don finish for my mouth, make una helep me put mouth for dis matter. I dey wait for una comments..
Monday, October 30, 2006
Saturday, October 28, 2006
Dis NEPA Sef...

Abi na PHCN dem dey call demselves nowadays. Power Holding Company of Nigeria, Please Hold Candles Now. I don wake up for de past two hours and dem don hold de power since, I no fit do any work. I just dey look like lukozade for inside darkness.
Meanwhile if una see de kain bill dem dey bring for our house ehn? First of all we neva see any PHCN official wey come read meter, dem talk say na estimate, abi guesstimate. I just dey wonder why last month say dey neva guestimate say our transformer pafuka and we only get light for two days. I tire.
Akadaites una no go put mouth for dis palava?
Friday, October 27, 2006
Mr. Lecturers Monopoly
No be talk am o! but e be like say members of de Akademik Board wan break de monopoly of Mr. Lecturer for dis campus. The list of impeachable offences include:(1) selling handouts at exhorbitant prizes
(2) conducting his first lecture of the semester under the influence of palmwine
(3) still being the most popular teacher on campus
Mr Lecturer has descibed the antics of these "whipper snappers" as balderash and not being able to hold water.

Akadaites..make una state de reason why una love Mr. Lecturer..
New Session
I salut all of una for dis our ogbonge Campus. I know say una don tire for de Akademik Board wey just suspend school indefinitely sha. Make una no vex.De tin be say anoder session don begin and Mr. Lecturer talk say anybody wey no buy him handout for de begining of dis session don get automatic carry over..
As for me, I still dey survey de new intakes (Jambites). I go yarn you de results of my survey very soon for inside dis my lecture notes (blog)...
Vice Chancellor talk say dem dey renovate de campus sef (www.akadacampus.com) and dem dey build a bigger undergound classroom (www.konkobelo.com). My people, better tins dey happen o. Schwepppeess...
Subscribe to:
Comments (Atom)