Monday, October 30, 2006

Anoder Plane Crash, Na Wa Ooo.

Abeg make una helep me for dis our obodo Nigeria o. Yesterday na BLACK Sunday as we hear de news again say anoder ADC plane crash for Abuja. In fact I no fit write anitin yesterday as my whole mind just spoil..may the souls of the departed rest in peace. Amen.

But come o, de news wey we hear be say de pilot no gree hear wen dem give instruction say becos weather dey bad make all aeroplane tanda for 10 minutes. Hmmm na wa. De question wey I wan ask na shay our airport don become like Ojuelegba bus stop where bus driver no dey listen to yellow fever? Abi how come we dey hear say pilot no listen to the caution of air traffic controllers ehn??

Akadaites, in fact talk don finish for my mouth, make una helep me put mouth for dis matter. I dey wait for una comments..

No comments: