Friday, October 27, 2006

New Session

I salut all of una for dis our ogbonge Campus. I know say una don tire for de Akademik Board wey just suspend school indefinitely sha. Make una no vex.

De tin be say an
oder session don begin and Mr. Lecturer talk say anybody wey no buy him handout for de begining of dis session don get automatic carry over..


As for me, I still dey survey de new intakes (Jambites). I go yarn you de results of my survey very soon for inside dis my lecture notes (blog)...

Vice Chancellor talk say dem dey renovate de campus sef (
www.akadacampus.com) and dem dey build a bigger undergound classroom (www.konkobelo.com). My people, better tins dey happen o. Schwepppeess...

4 comments:

Yemi Atanda said...

Wakawaka don change cloth? U sure say u dey Waka since? U na welkome back to campus oooo, my people.

Anonymous said...

waka waka where u dey since, i don dey follow ur tory no be 2day, i hope say na beta go dey inside mama carol cooking pot this time, ayuwa me sef welcome u bak to dis ogbonge campus

Anonymous said...

Waka, na ya eye be dis? longest time. I don talk say until AkadaCampus re-open, i no dey go any oda school. Thank God say I neva get grey hairs before our school re-open.

taiwo said...

how u dey, welcome back